Текст песни Dem Militarize Democracy - Femi Kuti
Military don taste power
Dem no wan leave leadership alone
Even in this democratic setting
Dem still dey manipulate dey go
These master coup plotters
Fathers of corruption, we dey watch their show
As they refuse to enter Barracks
Wey be their house, wey be their home
Dem militarize democracy
Military men as senators
Dem militarize democracy
Military men as governors
Dem militarize democracy
Military men as legislators
Dem militarize democracy
Na military man Abubakar
Oversee the constitution
Na military men Obasanjo and Atiku
Win the elections
Na military man Obasanjo
Put Jonathan Administration
Na military man Buhari
Come be the main opposition
Dem militarize democracy
Military man David Mark be senator
Dem militarize democracy
Military man Oyiniola be governor
Dem militarize democracy
Military man as legislators
Dem militarize democracy
Dem militarize democracy

Внимание! Не стесняйтесь оставлять отзывы.