Styl-Plus - Only God Lyrics

Lyrics Only God - Styl-Plus



Ahah let's go
Ah eh Ah
Ah eh Ah
Ah eh Ah
Yes o (eyooo eh)
Style Plus io (eyooo eh)
Mekoyo (eyooo eh) we don come again io (eyooo eh)
Trust in God ehh, believe in God ehh
Trust in God ehh omo believe in God ehh
Na only God know who go make money o
(Na only God know, na only God know)
Na only God where you u di make money o
(Na only God know, na only God know)
E know when u dey suffer eyooo eh
E know when u go hammer eyooo eh
Anything wey you get make u thank God o eyooo eh
Anything wey you want make u ask God o eyooo eh
My people take heart io
We know say sometimes e dey hard io
Weda you dey naija or overseas io
We know say to survive no easy ooo
Some people wan go school io
But dem no get money, dem dey road di suffer
People wey go school io wey suppose get money
Follow dey road di rough'am
But if you believe in papa God io
Job and money go soon come io
You go stop to dey cry and start to laugh io
In God's time cuz na only God know
Na only God know who go make money o
(Na only God know, na only God know)
Na only God where you u di make money o
(Na only God know, na only God know)
E know when u dey suffer eyooo eh
E know when u go hammer eyooo eh
Anything wey you get make u thank God o eyooo eh
Anything wey you want make u ask God o eyooo eh
My people make wona hear me o
Cuz the way wona dey do e don dey fear me o
You dey see the money wey ya brother get io
You come dey jealous, di shokoto and shert io
Some people wan confuse you o
You go see thier money, run start to hustle
No allow dem use you o
Dem go play you cornie, turn start to curse you
But if you believe in papa God io
Bad bad people dem go all run io
You go stop to hustle and start to bubble o
In God's time cuz na only God know
Na only God know who go make money o
(Na only God know, na only God know)
Na only God where you u di make money o
(Na only God know, na only God know)
E know when u dey suffer eyooo eh
E know when u go hammer eyooo eh
Anything wey you get make u thank God o eyooo eh
Anything wey you want make u ask God o eyooo eh
(Eyooo eh) if you believe in God eh
(Eyooo eh) follow me sing eh
(Eyooo eh) everybody come sing along eh
Ohoo Trust in God ehh, believe in God ehh
Trust in God ehh omo believe in God ehh
I know what's going on in your mind
You think you're running out of time
Your friend's got a house and a flashy car
You feel you're so so far behind
But as the bees di produce thier honey eh
Na so you go make your money eh
And if you trust in God
Omo he will take you to the top
Omo celebrate and dance io
Don't let anybody change you oo
Na only God di get get get io
Cuz na only God know
Na only God know who go make money o
(Na only God know, na only God know)
Na only God where you u di make money o
(Na only God know, na only God know)
E know when u dey suffer eyooo eh
E know when u go hammer eyooo eh
Anything wey you get make u thank God o eyooo eh
Anything wey you want make u ask God
Anything wey you get make u thank God o eyooo eh
Anything wey you want make u ask God o eyooo eh
Eyo eyo (eyooo eh)
Eyo ooo (eyooo eh)
Eyo eyo e- (eyooo eh)
Eyooo...



Writer(s): styl-plus


Styl-Plus - Unbreakable
Album Unbreakable
date of release
20-05-2016




Attention! Feel free to leave feedback.