SwaggBilli - Nobody Lyrics

Lyrics Nobody - SwaggBilli




Ye! Eh! Eh
Yeahh
They call me SwaggBilli
Billi 1, 2 mia jowajo
Me i wan know that thing
Wey be say man need to do
Money go dey come my way
Big big success i no go fail
I don tey for D street
No be today eh eh
Mama tell me work and pray
Watch your steps and the things you say
No competition do your thing your way
Don't be so stupid and don't be a Fool uh uh
Make you no go do Juju
Baba God get Biggy plans for you
One day One day he go remember you
But i wan wake up in the morning
Make i sing my song
Count my blessings one by one
I know say this life na turn by turn
Baba me sef want to chop my own, So me i say
Nobody know wetin tomorrow go be eh
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, ye eh eh
Nobody know wetin tomorrow go be eh
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, Woah oh oh, Iye
I dey pray i dey do Fasting
Some say make i leave that thing
Waka for the Benz and the Bugatti
No be say the boy no fit do bad thing
I want to hustle maka Poverty
Everyday make i dey do faaji
I get am before no be Property, say
If you wire my Aza steady on a roll
Mama go smile when she call for phone
Door go dey open everywhere i go
Do all the things i no fit do before
I say Eeh! eh eh, Ooh oh oh
One day the hustle go pay eh eh
As i reach here nobody know oh oh
Never give up my G bcos say
Nobody know wetin tomorrow go be eh
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, ye eh eh
Nobody know wetin tomorrow go be eh
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, Woah oh oh, Iye
If i broke i no happy make
All of my niggas dey ginger me
I no dey fear death oh
Wetin me i fear na Poverty, eh
Bcoz e get as e be when person pikin
No get money, Nobody dey for me, say
Nobody know wetin tomorrow go be eh
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, ye eh eh
Nobody know wetin tomorrow go be eh!
Make we dey pray to Jah, make we no loss
Make he show us the way eh eh, Woah oh oh, Iye



Writer(s): Omoke Samuel



Attention! Feel free to leave feedback.
//}