Erigga feat. Oritsefemi - Wicked Man текст песни

Текст песни Wicked Man - Erigga feat. Oritsefemi



O no Na na na na na
Oritse Femi oo
Its ur Bwoi Erigga New Money
Akpos, Omo I no like the Way u dey Behave
U dey always dey do like say na U wicked pass for this Life abi?
No worry, na God go judge u.
He No know, Free Am
2 O Clock for night, I sit down my Doormot dey Bloaw/
With the hope say all the Pains go Cormot, as how/
I Just receive one mumu phone call/
My Paddy for Ekpoma, dem just use am count score/
Sabi Boy, No Be today dem don dey tam am/
I even hear say who Dog am na same person wey Bam am/
This Na Guy man wey don commit tire for Port/
Use Kala Face U, u no dey leave till fire Comot/
Number One Butcher, U no wan follow am Do/
Cos Korokoro omo boy go duck u for School/
Na so e name tey cast, even when e Kawa/
Enter B-Side, e fuck up no still Sour/
Na So e just Be, person wey be say dey follow u roll/
Na d same person wey go change am for u when its time to go/
Dem?? The Guy na Runs, omo boy no know/
Hook(Oritse Femi):
Hey Mr Wicked Man/
Turn around and see what happening Behind U/
U just dey take us for a Fool/
Bcos we dey use small mind dey serve U/
Hey Mr Wicked man/
Change Ur ways/
All this ur bad bad tin wey u dey do/
One day go be your judgement day/
One day, judgement day/
One day one day one day go be One day/
Mama go market, Pikin go school, Papa go work/
All this na make dem fit arrange wetin pikin go chop/
The Small Eba and Ice fish wey dem arrange give am/
Na wetin go dey her belle, till evening come meet am/
Her Uniform na Tear Tear, but Papa no care/
E own na to sit down with compound men dey drink beer/
Dey argue Politics, e so love Jona/
But after Subsidy knack am, na Once e bone am/
On this faithful Day, Mileh dey market dey sell/
Pileh need Bar Badly, so he go block her for there/
E no too tey, boys enter market throway for air/
Flying bullet knack mama and papa for there/
Pikin don reach house, no key to enter house/
Cos Pileh forget to drop key when e dey go out/
She don siddon her dooormot, day don dey Dark/
Repeat Hook
Which Can life be this, wey one man go siddon/
On e own P, dey inflict pain on his fellow man/
Boko dey bomb for one side, that one no pain dem/
Na the small fuel wey I dey see put inside my ride/
People dey die for protest, government turn their Face/
People wey police kill, wetin con happen to d Case/
Get mind come TV, dey Apologize/
When who don die don die, what is wrong with this guys?/
Shey na Bad tin we do, to allow u rule us?/
Our own brother for government, see wetin u dey do us/
Same God wey carry Abacha and Ghadafi go/
Still dey, no be threat, na the Truth I just dey yarn u so/
Repeat Hook
It is what it is mahn
What goes around comes around mahn.
Nothing Loss o
Normal Level, u Understand



Авторы: Erigga


Erigga feat. Oritsefemi - The Erigma
Альбом The Erigma
дата релиза
28-02-2019



Внимание! Не стесняйтесь оставлять отзывы.