Prinx Emmanuel - My Pikin Lyrics

Lyrics My Pikin - Prinx Emmanuel



Correct sound
Ah eh eh eh eh
Mirus boy prince oluwa dey with us
Mama tell me say pikin oya come here
I get so many things wey you suppose to come hear
I tell say I dey come
Say I dey iron trouser
She say make you stop that
Oya come here find chair make you sit down
She say make you hold your ear
I hold my ear,
I kon dey fear and na so I ask her mama na wetin dey sup
She say my pikin my pikin as you carry your bag dey go school
Make you no go there go fall my hand aha
My pikin my pikin oh as you carry your bag dey go
University make you no go there go fall my hand aha
She say make you no forget oh na only you wey
I get oh, na you go carry me commot for ghetto
Oya go read book and make me proud
Eh eh
Hoo hoo hoooo {parararara}
I don reach school everything nice and cool
E no tey I don forget everything mama talk
I don draw tattoo
They don dey call me baddest
My name na the king of the planet
I don dey follow the men wey know the way, we run the bracket ohh
Na so we dey smoke everything that is smokeable
Drink everything that is drinkable
Fuck everything that is fuckable
Buy anything that is dura
Dem say our next movement na to go carry senator for airport
I tell dem say I no fit do that one
That one na high tension ohh
Dem say make I go, make I go say I be fear, fear
Say I no reach to be man, I just get bya bya
No forget oh na only you wey I get oh
Na you go carry me commot for ghetto
So one night I enter house
Dem just bring light, I on TV
Na network news I see my friends for headlines
Yawa don gass oh, yawa don gass oh move
Na for kirikiri na for kirikiri like that ohh
My pikin my pikin as you carry your bag dey go school
Make you no go there go fall my hand aha
My pikin my pikin oh as you carry your bag dey go university
Make you no go there go fall my hand aha
She say make you no forget oh
Na only you wey I get oh
Na you go carry me commot for ghetto
Oya go read book and make me proud
Eh
Ah ehh
Prinx Emmanuel
Mirus boy oohh
Its mirus empire ladies and gentlemen
Correct sound



Writer(s): Prinx Emmanuel


Prinx Emmanuel - My Pikin
Album My Pikin
date of release
27-04-2018




Attention! Feel free to leave feedback.