The Kazez - Time Lyrics

Lyrics Time - The Kazez



Yeah
It's the K A Z E Z
Time no be man friend
Time I like anyone
Time no dey give a fuck
But e Dey go and e dey come
Time no dey go olympics
But e too like to dey run
For things wey money no fit buy
Na time be number one
With time you go understand
With time you go grow
With time everything wey Dey for darkness go show
With time e go better but na with time we go know
Cuz time na river wey no go stop to dey flow
Na time wey dem born you, you know
You no know the time, wey you go go
Cuz time na the difference between the young and the old
Na time be difference between the hot and the cold
Na time separate taye and kehinde
Omokehinde gbegbon
But oun lo gbeyin de
Sometimes mehn, time is fucked up
I can't say sometimes without time and that is fucked up
Time is of the essence
Time is of the future of the past and of the present
If life na teacher, time must be the lesson
Take a chill pill, there's a time for every person
My time, your time
You fit get all time for world but you still need more time
I don try invest for time but time no pay
I for like dey talk dey go but time no dey
Tick tock, tick tock, tick tock, tick tick tok
Tick tock, tick tock, there's more to time than it says up on the clock
Tick tock, tick tock, tick tock, tick tick tok
Tick tock, tick tock, there's more to time than it says up on the clock
We make clock but we no fit make time
Throw your watch for dustbin, you just dey waste time
Time no dey rest, time no get break time
You fit cook with curry but e to still take thyme
See, time is the difference between cut and bleed
Time is the difference between do and did
Time is the difference between plant and seed
Time no dey do exam but e too like to dey read
Time is that mystery we always thought we knew
Pass time and time go still dey ahead of you
You don spend time, you don spend time
Nothing wey you fit do
You no fit collect change, nobody for refund you
Time na something wey man no fit comprehend
Sometimes I dey wonder what currency represents
Cuz when we dey make money na time we dey spend
And when we dey spend money na time we dey spend
Time is very powerful but we dey use am
So make we appreciate time, make we no dey abuse am
Time finish, time start
Na when one person die one person dey give birth
And I'm Kay, talk about time yeah



Writer(s): Taiwo Kassim


The Kazez - Time
Album Time
date of release
14-02-2017

1 Time




Attention! Feel free to leave feedback.