Bantu - Disrupt the Programme текст песни

Текст песни Disrupt the Programme - Bantu



We must to disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
Disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
Oga no tell me say make I hold my anger
Make I no make noise make I cooli temper
When herdsmen dey slaughter, massacre we brother
From Benue, Ekiti, Enugu, Zamfara
Hundreds dey die dey peme like fly
Blood e dey flow government dey turn eye
Silent indifference dem go play with our sense
Point hand for Libya to bury di matter
We must to disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
Disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
How long we go dey wait dey sit down debate
Dey waste our saliva dey yan for social media
Nothing go change if we no organise
Call out their bullshit and cut them to size
Na we get di strength na we get di numbers
Nothing to fear my brother rise up my sisters
By vote or by force we must wipe di slate clean
This yẹ'yẹ' politirikshians must enter dustbin
We must to disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
Disrupt the programme
Put sand sand for their garri
Regain our freedom by any means necessary
Freedom The clock is ticking
Freedom It's all or nothing
Freedom Don't come for begging
Freedom Stand for something
Freedom It's all or nothing
Freedom The clock is ticking
Freedom We done with talking
Freedom Just stand for something



Авторы: Abiodun Oke, Adegoke Odukoya, Akin Akinhanmi, Akinkunmi Olagunju, Ayomiku Aigbokhan, Babajide Okegbenro, Dare Odede, Isaiah Odeyale, Olufemi Sanni, Opeyemi Oyewande, Peter Sadibo


Bantu - Disrupt the Programme
Альбом Disrupt the Programme
дата релиза
10-04-2020




Внимание! Не стесняйтесь оставлять отзывы.