Versatile - Inside Life текст песни

Текст песни Inside Life - Versatile



Emeka comot for house, e neva chop since morning
E carry salt wash him mouth, he never pay rent since January
Na wetin poverty dey do pesin-i oo
E dey live with him wife, 8 children,
Him father, him mother, confusion break-i bone-i
Ah ah eh, inside life-u o, plenty things wey man dey see.
The God wey do am for you today, go surely come do am for me.
No condition is permanent-i o, uwa n'eme ntughari.
Won ni olowo l'aiye mo,
From ghetto to mansion my brother we go make am.
Biola don find work tire, him mama dey hospital, na double wahala.
E manage hustle small-i o, e enter one chance, e enter another palava.
Na which kind life be dis, wetin man pikin-i go do?
E don do mechanic, carpenter, okada, tailor, my brother wetin happen.
Ah ah eh, inside life-u o, plenty things wey man dey see.
The God wey do am for you today, go surely come do am for me.
No condition is permanent-i o, uwa n'eme ntughari.
Won ni olowo l'aiye mo,
From ghetto to mansion my brother we go make am.
You dey drink garri both night and day.
You no get money, alert-i don tey.
You don get tear-tear for shokoto,
No forget say nobody knows tomorrow.
Bolaji (you go make am)
Halima (you go make am)
Chinedu (you go make am)
Me and you (we go make am)
Nkechi (you go make am)
Sikira (you go make am)
Chinelo (you go make am)
Everybody go make am
Ah ah eh, inside life-u o, plenty things wey man dey see.
The God wey do am for you today, go surely come do am for me.
No condition is permanent-i o, uwa n'eme ntughari.
Won ni olowo l'aiye mo,
From ghetto to mansion my brother we go make am.



Авторы: Eze Alice T.


Versatile - Inside Life
Альбом Inside Life
дата релиза
04-07-2020



Внимание! Не стесняйтесь оставлять отзывы.