Rema - NOW I KNOW Lyrics

Lyrics NOW I KNOW - Rema



P
(Day-Day-Daytrip took it to ten)
All of my trauma dey hit me from many years ago
All of my childhood I lost 'cause I wan feed family
Inside my heart, so dark but my face e no dey show
I no dey talk, I no dey comot, I just wan dey alone
Sleeping pills no dey work, so I steady overdose
Fear no go let me talk things wey I do for the ones I love
Everybody too selfish to see from my angle, oh
Do 99 but I no do one, still it's not enough
Na now I know who dey for me
All those I love turned enemies
And now I know who dey for me
All those I trust turned enemies
I dey move like Messi when he dey for Barcelo'
E get as God go bless person, them go talk say na Devil oh
Me, I no dey ask for favor, small time, they go talk say I dey owe
Na why I dey like to dey face all my problems on my own
She tell me make I tell her all the pains wey I always envelope
Right from my childhood, I steady dey thug with the feelings' wey I dey hold (uhh)
Many battles I dey fight but regardless, I'm steady on the road (ahh)
"Keep my guy Crayon safe for me," na im I tell Solo
Na now I know (I know) who dey for me (ah)
All those I love turned enemies (hm)
And now I know (I know) who dey for me
All those I trust turned enemies (ahh)
Na now I know who dey for me (I know, I know, I know)
All those I love turned enemies (ooh)
And now I know who dey for me
All those I trust turned enemies



Writer(s): Oredope Peace


Rema - HEIS
Album HEIS
date of release
10-07-2024




Attention! Feel free to leave feedback.